AMANPOUR:
Well done Zazu for joining us for CNN, I don hear so much about you.
ZAZU:
Ah na you try pass, na only oyinbos like you I dey like talk to just like my presido and oga Goodluck.

AMANPOUR:
Make I first ask this question, your oga get one kain ogbonge name o. How im take get that kain name.
ZAZU:
A nor know o, na im old man wahala be that. Dem sabi name one kain name for yonder.

AMANPOUR:
Your oga get good luck and you sure say im name go save am for all the plenty wahala wey full im plate so?
ZAZU:
I nor sure say good luck matter go do for this matter. As we dey yarn so, plenty kasala dey. Plenty things don spoil since presido comot dey sick, boy don para things nor be small.

AMANPOUR:
Ok make I ask you dis, as e be say your oga na the active president, na true talk say Yar’Adua nor well?
ZAZU:
Na wao, me I be think say na CNN be this? You mean say una nor know say water don pass garri since how many moons ago? Shuo, una funny for here o!

AMANPOUR:
Ok, nor vex, I just want take style ask you sha. But your oga don see am (Yar’Adua) since the man come back from Saudi Arabia?
ZAZU:
Who sai! How im wan take see am? You don see where pig see im own yansh?

AMANPOUR:
Why not?
ZAZU:
Na im be say you nor know Yar’Adua madam be that. Dem nor want make any person wey nor be cabal member see how matter don worwor reach. Nobody for we side don see presido o, even oga David Mark wey dey talk para para up and down never see the man. Anyway sha, oga never see presido o.

AMANPOUR:
Dat kain thing nor dey cause gbege and tension so for your country?
ZAZU:
Yes Amanpour my sister, how we go do now, nor be as hunchback see imself e dey take waka. Abi nor be small small dem dey chase rat wey dey inside pot. We nor fit tell im family wetin to do na.

AMANPOUR:
But you go want make the family let your oga see presido?
ZAZU:
Na byforce. My oga nor need to see presido, wetin im wan see am for sef. Since madam say nobody go see am, then make she begin do mai guard na, abi?

AMANPOUR:
Na so. Ok Zazu, make I ask you…wetin dey do the man sef?
ZAZU:
Amanpour, I nor fit tell you o. Na only im doctor know wetin dey kpokpo the guy sha, dem nor dey take ordinary eye see water wey dey inside coconut.

AMANPOUR:
So you mean say dem nor yarn Goodluck wetin dey kpokpo the guy?
ZAZU:
Na so we see am o, dem nor gree yarn my oga o.
AMANPOUR:
Dem yarn anybody atall atall?

ZAZU:
Whosai. Before before sha, dem just talk say na one kain disease wey man pikin nor fit pronounce na im dey worry the guy. Na so we see am reach o.
AMANPOUR:
So presido dey see all the prophets and imam, why im nor want make your oga see am?

ZAZU:
The matter tire me o. Anyway sha, na prayer the man need, and you know say our people sabi God pass Jesus Christ.
AMANPOUR:
You think Madam and im cabal nor wan respect your oga and im own cabal wey im put together so?

ZAZU:
Nor be my mouth you go hear say chicken nor dey like snake wey dey chop egg o. Dem think say my oga na inferior and old presido na superior, dem never know anything. You know say my oga sabi do like who nor know anything, and before you know it…Kpishaannnn, im go take Chinese karate cut people down left right and central.
AMANPOUR:
You think say Yar’adua go smell power again so?

ZAZU:
I nor fit talk o. Na only God fit know who go see power and who nor go lie down for inside ambulance. We self nor dey worry for that kain thing sha, because we know say tortoise nor dey run four forty.
AMANPOUR:
Na your oga be active presido now, till una hold election for 2011, abi?

ZAZU:
Amanpour, that na question abi dem send you come?
AMANPOUR:
No na question o. Nor vex. Anyway sha, wetin you think say be your oga matter wey dem burn for fire now now?

ZAZU:
Na power. Oga want power. Agenda number one na power. Agenda number two na power.
AMANPOUR:
You mean electricity power abi which one?

ZAZU:
Madam power na power. The thing wey I fit tell you now say oga want make power dey. Chikena!
AMANPOUR:
Ok Zazu, I feel you my guy. But for your oga to get power to work, shebi America talk say make im drive Maurice Iwu. You sure say your oga get the liver to take drive that man comot?

ZAZU:
Na God dey drive fly for cow wey nor get tail na. But the thing be say nor be only Iwu be the wahala wey oga get sha, Babangida dey there, Buhari dey there, even Obasanjo dey there self and all these people na sojas. But sha o, if you ask me my oga suppose drive everybody wey dey for im neck for INEC, otherwise na the same old story sha. Na who get plenty money na im dem go give power. And na who get power dey get money for our country. So you see why I tell you say na power be oga major agenda.
AMANPOUR:
I see. But your oga do like say im dey defend INEC chairman?

ZAZU:
My oga na the kain person wey be say if im never pursue dog take bone comot from im hand, im nor dey vex with the person wey e open the pot of soup o. You know say my oga nor dey quick talk, but im fit wake up tomorrow now, you go hear say Maurice Iwu don dey sell kuli-kuli for street o. Ask Aondoakaa!
AMANPOUR:
But you yourself Zazu, you think say Iwu na bad guy?

ZAZU:
Hmmm madam, Iwu wuruwuru too much sha. No time wey dem do election wey the man name nor go surface for potorpotor. I know say oga me go talk say the matter pass Iwu, but my people say na the head of yam be yam. Oga go find how im go take comot Iwu for dia sha.
AMANPOUR:
OK. You sure say your oga go run for 2011?

ZAZU:
Where im dey run go?
AMANPOUR:
You too funny Zazu…I mean whether your oga wan run to be presido for 2011?

ZAZU:
Oh I see. We nor dey run for our country o. Person wey wan be presido go siddon look well well and begin find how im go take win the election with Ghana-Must- Go bag.
AMANPOUR:
What is Ghana-Must-Go?

ZAZU:
Hehehe. Na our politician currency be that.
AMANPOUR:
Zazu, you do well. I Gbadun your style well well. Make you take am easy o.

ZAZU:
Na you try pass. We go yarn later.